Kishore Kumar Hits

Corizo - Fire текст песни

Исполнитель: Corizo

альбом: Fire


El fucking Corizo Skelvin
Got me up in this bitch
Dat kind thing na
Young g mozes on d play
You fit smoke here
But no burn my carpet
Light up your ganger start reminiscing
Mama Ifeanyi give me two alomo
Make I mix am down with my cold Pepsi
Many start life
But many they don die
Worst comes to worst
Me self I don try
Life is a bitch we fuck am
Back and front
I was aggressive
Too bad my condom tear
Dream chaser but I go like to quit
Give up no join but I wan retreat
I keep on pushing corizo is pregnant
If I born today I hope e go be twins
For Osalu how I go raise the kids
Abi I go use my last pikin for ritual?
But I love Isaac so I can not
Water don pass garri
Na to pour many groundnut
There is fire on the mountain
And no body japa
As long as say na money talk oh,
No man go fit answer.
For downtown ojuelegba,
Person sell him papa,
Dem just dey find money,
Dem no wan know
How e go take enter
Yo yo yo yo no do ojoro,
No do today forget tomorrow
Dey o broda
Yo yo yo yo no go dey mara oh,
Until water don pass garri,
No be sorrow
I tell them, just relax,
The money go come
I dey motivate the trenches
For the boys to ball
We the voice of d street
We Bringing south to the world
Who say we no go blow
If no be Lagos, no be God
Way back, I drink garri Like I'm cursed
Waiting my eyes see for Auchi poly
Pass my course
Oppression everywhere
They try put me for cult
It wasn't easy for me and my team
If no be God!!!
Thank God for the life we live
Money dey come
Some of our mate don leave
And yet to come
Some die for love,
Why some die for hustle
We dey pray oh lord
No let the story be gone soon
Dat kind thing na!!!
Our Tomorrow sure
Why Some tryna make it
Bros do waiting your mate Dey do
If you wanna make it
I get master's degree
But no b dat one I go chop
500 iTunes pass am,
Way my younger ones Dey chop
There is fire on the mountain
And no body japa
As long as say na money talk oh,
No man go fit answer.
For downtown ojuelegba,
Person sell him papa,
Them just dey find money,
Dem no wan know
How e go take enter
Yo yo yo yo no do ojoro,
No do today forget tomorrow
Dey o broda
Yo yo yo yo no go dey mara oh,
Until water don pass garri,
No be sorrow

Поcмотреть все песни артиста

Другие альбомы исполнителя

Похожие исполнители

Ayox

Исполнитель

Dremo

Исполнитель

Jeriq

Исполнитель