Kishore Kumar Hits

Snazzygrin - Paddy текст песни

Исполнитель: Snazzygrin

альбом: Gene6ix of Snazzygrin


He-he-he-he- Graham D nai do the beat
Yes! Oko e done hook you
RAP
Listen!
This na the story of my real G
Paddy want to make money, Paddy want to buy jeep
Paddy dey hustle everyday no holiday
Anybody when paddy see him dey ask were the money dey
Family too poor, paddy nor finish school
Poverty life when you see nor really good
Popsi done leggo, mumsy dey sick o
And the sister dey one side dey request for school fees o
Paddy get to make plans, paddy get to travel na
Things when dey happen for family him nor fit handle nah
Paddy go to lagos go meet him own paddy,
Before him own paddy make am to house boy paddy
Allah hammer allah inshalla

Abeg try to make money – because suffer nor good o
Abeg try to make money – because suffer nor sweet o
Allah hammer allah inshalla

RAP 2
Listen!
Back then paddy was fucking broke
Him nor dey smile for brokenness nor be funny joke
Na who get money dey buy wetin him like chop
Even pastor when nor dey see tithe nor go like church
You when dey hustle nor worry, you go make am
Ogbeni work and pray, one day you go make am
Life na step by step, e be like ladder
Nor go shook hand for trouble gather piss like bladder
Oluwa nor dey sleep, him nor dey slumber
Wetin paddy pass through, paddy I nor remember
Na one minute call change paddy life, I remember
Paddy done dey book flight, Paddy done dey live well
Paddy done dey buy house, mumsy done dey live well
Paddy done dey buy anything when him want o
Paddy done dey cruise in a benz, how e come be?
Listen! That's life for you
Sometimes e go hard and soft for you
Paddy nor forget oluwa when run am for you
100k for him tithe na him run am for you – oshe
Allah hammer allah inshalla

Abeg try to make money – because suffer nor good o
Abeg try to make money – because suffer nor sweet o yeah-eh
Allah hammer allah inshalla
Yes! Oko e done hook you?
Graham D nai do the beat 9jaxclusivemusiq.com
True life story.

Поcмотреть все песни артиста

Другие альбомы исполнителя

Похожие исполнители

Kashy

Исполнитель

Twest

Исполнитель

Tia

Исполнитель

Kabex

Исполнитель